Gå direkte til innholdet
Abuja Na Kpangba and Other Poems in Naija Pidgin
Spar

Abuja Na Kpangba and Other Poems in Naija Pidgin

pocket, 2022
Engelsk
Abuja Na Kpangba and other poems na di first collection of poems for Pidgin wey anybody go write since 1982 wen Frank Aig-Imoukhuede first publish im poetry book for pidgin wey dem dey call Pidgin Stew and Sufferhead. Di first time Oribhabor bin publish dis poems na for Naija languej spelling system wey Naija langwej Akademi (NLA) bin dey try to put together. But as the spelling no work well, dis edition of dis book na for Naija Pidgin wey everybody go fit connect with easily. Dis book of poems na major work because, e contain fifty one diffren poems wey concern we all for Nigeria.

For dis book, Oribhabor give powerful message about how Nigeria and im pipul dey waka. Di poems carry diffren level of how things dey happen since dem born am for im country. Since pikin no fit tok sey im mama no be im mama again, sek of sey e worwor, na so Oribhabor dey want mek we know Naija Pidgin and see ourselves as ambassadors of di language. E want mek we know sey, as life get sweet part for Naija, na so e get tough part. E want mek we feel di wey Naija pipul heart dey beat and di kind of change wey dey happen everyday.

Whether you tall or shot, whether you fat or slim, whether you get money or no get money, dis book na for everybody. You go learn plenty lesson and get suplus sense on how to tek succeed for Naija. Na everybody book for everybody.

Divid Esizimetor
Benin-City, Nigeria
October, 2009

ISBN
9789789122677
Språk
Engelsk
Vekt
113 gram
Utgivelsesdato
2.10.2022
Antall sider
82