
Abuja Na Kpangba and Other Poems in Naija Pidgin
For dis book, Oribhabor give powerful message about how Nigeria and im pipul dey waka. Di poems carry diffren level of how things dey happen since dem born am for im country. Since pikin no fit tok sey im mama no be im mama again, sek of sey e worwor, na so Oribhabor dey want mek we know Naija Pidgin and see ourselves as ambassadors of di language. E want mek we know sey, as life get sweet part for Naija, na so e get tough part. E want mek we feel di wey Naija pipul heart dey beat and di kind of change wey dey happen everyday.
Whether you tall or shot, whether you fat or slim, whether you get money or no get money, dis book na for everybody. You go learn plenty lesson and get suplus sense on how to tek succeed for Naija. Na everybody book for everybody.
Divid Esizimetor
Benin-City, Nigeria
October, 2009
- Författare
- Eriata Oribhabor
- ISBN
- 9789789122677
- Språk
- Engelska
- Vikt
- 113 gram
- Utgivningsdatum
- 2022-10-02
- Sidor
- 82